Nor be news again say two Nigeria afro beat artist don dey use small style throw word give each oda for some days now for dat handle wey we dey call X wey be former twitter. Sotey Davido com tori for im X handle say Wizzy be like say e nid paracetamol. See below as Davido take tok am for im X handle after Wizkid say e be like say Davido dey delusional.
Month: April 2024
NANS say dem go protest if di fuel scarcity kontiniu
National Association of Nigerian Students (NANS) don tori say dem go start mass protest if gworment nor do everythin to take address di on going fuel scarcity for almost everywhia for di kontry right now. NANS com still tori say if Mr. Mele Kyari wey bi di oga kpata kpata for di Nigerian National Petroleum Company Limited wey be NNPCL nor fit take actions to solve di fuel scarcity mata, make im kuku resign. Na di Senate President for di association Babatunde Akinteye, nai tori dis mata on Monday say,…
Central Bank don ban Opay, moniepoint, kuda plus odas from opening new accounts
Central Bank of Nigeria, (CBN), don ban Opay, moniepoint, Kuda, plus some odas, sake of say make dem nor open any new account for new customers for now. Dem say di rison for di ban na becos dem beliv say dis platform dey do mago mago with cryptocurrency wey dey disturb di stability of di naira.
Govnor Obaseki of Edo State don increase workers salary to N70,000
Good news for Edo state workers, as govnor Godwin Obaseki don increase dia salary from N40,000 to N70,000, and dis increment according to di govnor, go start to happen as from May 1st 2024, dat day also double as workers day and na holiday. Godwin Obaseki tori dis increment wen im dey open di new labour house secretariat complex wey dem build for unions for di state wey dey along Temboga road for Ikpoba hill for Benin city.
Police don arrest 16 suspects for Rivers ontop di female police officer wey dem beat and kpai
Rivers state police don arrest almost 16 pipo sake of say dem beat and kpai one christiana Erekere wey be police inspector. Dem say dis mata happen on April 25th as Christiana Erekere bi dey duty dat day before di beating mata wey result to her kpaing, and na for front of Taabaa Police Station wey dey Khanna local government area of Rivers State e for happen. Tori tok further say, na as Christiana bi stop some pipo for di normal routine checking, nai argument com start, and before you…
Army don catch one human trafficker for Lagos com rescue 22 years old victim
Nigerian Army don tori say dem don arrest one Mrs. Olushola Areke wey bi confirm human trafficker for Lagos State. Di Army statement on Monday tori say “Mrs. Olushola wey be di suspect, kidnap one Miss Fayoke Kunle 22 years old girl pikin of one Mrs Ainor Kunle, di tori say Mrs Kunle bi handover her pikin giv Olushola becos say she promise to help Fayoke di 22 years old pikin find work for Oshodi area. Tori com kontiniu say, instead of Olushola to find di work as she promise…
Court don stop Multi Choice make dem nor increase price of DStv and GOtv
Di three-member panel of di Competition and Consumer Protection Tribunal (CCPT) wey dey Abuja don give one order say make Multichoice nor increase di price of DStv and GOtv wey dem be plan, and na Saratu Shafii nai com give dis order on Monday. Dis new development dey happen after one Festus Onifade carry di mata of Multichoice increment go di consumer court. Na dere di court give order say make Multichoice nor do any increase until di court go finally decide on di mata.
Nor take anytin or anybodi for granted
As we dey joni for dis life, we go meet all mana, old, young poor rich good bad ugly peaceful troublemaker, evry borkus dem. Di good tin be say, all of dis put togeda, nai make dis life bi dis life, and di rison why you nor suppose to take anytin or anybody for granted be say, you never can tell who go rescue you wen some kai tori start to get tail sometimes. Sometimes sef na di person wey you dey use one kai eye take dey look say…
Pst Kumuyi of Deeper Life don advise youth to be agent of change
Pst Kumuyi wey be di general superintendent of Deeper Life Bible Church, don advise our youth to be agent of change and remove hand from any mago mago as dem dey waka thru dis life. Di pastor com tok say make youth always try to run away from things wey nor good for dia destiny and practice godly lifestyle and also stay focus. Na for one youth program wey dem hold for Aba Abia state na Pst Kumuyi for giv youth dis advise.
Nigerians for South Africa don cry out say dem dey expolit dem becos of NIN enrolment
Di Nigerian Citizens Association South Africa, West Cape, NICASA WC, wey bi di bodi wey gworment recognized for South Africa don tori say, di exploitation wey dem dey face sake of say dem wan enrol for NIN don too much. Na di Chairman of NICASA, Apostle Henry Ezumaha, and Leo Azebeokhai di Deputy Chairman, for Western Cape Province, nai tori dis mata concerning di yeye wey Nigerians dey reciv on top dis enrolment process of NIN. Dem com tori say di third party wey dey involve for di enrolment mata…