Seconds nai dey turn to minutes and minutes go turn to hours while hours go eventually become full day, nai make am be twenty four hours make one day.
Now di question be say, wetin you dey do with your seconds, your minute, your hours, and eventually your time?.
For some of us, di time dey do tik tok without anything to show for am, for some we dey wait for di perfect time before we take any steps towards wetin we plan to do for life; but di good news bi say di perfect time na di time wey you get right now.
So as you dey start your day, remember say time nor dey wait for anybody and make you use that twenty four hours well.
Have a beautiful day.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.