Dis dream, wetin e be sef? Dream get many features or definition, but most importantly we fit define dream as that aspiration, that ambition or that idea wey you dey cherish well well, so that your aspiration, ambition and that idea wey you dey always think about fit turn out to be di dream wey nature bless you with as you dey come dis world.
Now di question be say, why e be say most of us nor dey follow our dream?
According to di late Dr. Myles Munroe, him tok for one of e messages say, if you dey find where dreams for borku, you go need to waka reach cemetery, according to him, na cemetery nai di greatest author wey nor write e book dey, na there di greatest footballer wey no play dey, na there di docitor wey suppose discover one medicine wey for treat any disease dey, na there people wey no gree take di courage to do something about their dreams dey.
Also most times, na di fear of di unknown nai dey make many of us nor dey take di steps to take pursue our dreams, meanwhile if you check well, di fear of di unknown na just shadows, e nor really dey dere.
So today, as you dey start your day, I wan make you take di time take look inward and go down memory lane to know which dream you dey cherish that year wey you dey grow up, if you remember and e still dey your heart to do am, I encourage you make you take di courage to pursue that dream, if you don already find that dream and di fear of di unknown still dey make you nor take any step, I encourage you to take dat step today and di rest go be history.
You will be celebrated.
Have a beautiful day.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.