President Bola Tinubu don approve make dem establish di national health fellows programme wey go carry young people along and engage dem for all di 774 local government areas wey dey di country. Na Ajuri Ngelale, wey be di special adviser for media and publicity to presido nai tory dis mata on Monday, him tok say dem establish di programme and engagement with di focus to upgrade service delivery for all di 8,800 primary health care centers wey dey round council areas for di country. Ngelale com further tori say…
Day: April 9, 2024
Philip Shaibu vows to fight on
Philip Shaibu wey di state house of assembly just impeached on Monday as deputy governor don vow to fight on. Philip com describe di impeachment as illegal and witch hunting, say nah because of di ambition wey him get to contest di governorship election of di state under di People Democratic Party (PDP) nai make dem cook up allegations against him, and him go fight di impeachment. Shaibu com tok say di illegal impeachment as im describe am na heavy blow to democracy and di rule of law. Di former…
Omobayo Godwins don replace Philip Shaibu as deputy governor of Edo state
Godwin Obaseki wey be governor of Edo state don pick Omobayo Godwins as him deputy after di state house of assembly impeach Philip Shaibu. Di chief Judge, Justice Daniel Iyobosa Okungbowa nai swear Omoboya in as deputy governor on Monday. Remember say dem impeach Philip Shaibu on di grounds of misconduct say him commit perjury base on say he allegedly leak government secret.
Edo state house of Assembly don impeach deputy governor Philip Shaibu
Edo state house of assembly don finally impeach Philip Shaibu wey be di deputy governor of di state. Di house of assembly com impeach di deputy governor on Monday after dem adopt di report of di seven member probe panel wey dem set up to probe di allegation of gross misconduct against Philip Shaibu di deputy governor. Di assembly com tok say Philip Shaibu offence dey impeachable as dem accuse am say him commit perjury due to say him leak state government secret.
What are your daily thoughts
I just wan remind you say thoughts dey very powerful, nai make every of your thoughts, negative or positive get di way e take dey shape your life. But di good thing be say, no mata how your thoughts dey go, meaning if you dey always dey think negative thoughts, dis na di time to change and if you dey on di lane of always thinking positively, kotiniu to improve on that positive thoughts even when you think say you never see results. As you start your day, take time…