Philip Shaibu wey di state house of assembly just impeached on Monday as deputy governor don vow to fight on.
Philip com describe di impeachment as illegal and witch hunting, say nah because of di ambition wey him get to contest di governorship election of di state under di People Democratic Party (PDP) nai make dem cook up allegations against him, and him go fight di impeachment.
Shaibu com tok say di illegal impeachment as im describe am na heavy blow to democracy and di rule of law.
Di former deputy governor com tok say him call on all relevant bodies especially di judiciary to intervene for di mata, so that di rule of law go prevail.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.