President Bola Tinubu don approve make dem establish di national health fellows programme wey go carry young people along and engage dem for all di 774 local government areas wey dey di country.
Na Ajuri Ngelale, wey be di special adviser for media and publicity to presido nai tory dis mata on Monday, him tok say dem establish di programme and engagement with di focus to upgrade service delivery for all di 8,800 primary health care centers wey dey round council areas for di country.
Ngelale com further tori say di main responsibility of di young people wey dem go engage nah to monitor and track di development and performance of primary health care centers base on di finance wey those centers receive.
Him com further tori say dem go train dis young people so that them go dey equipped with all di tools dem go need for di tracking of performance.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.