Di people of Rafin Duma village for Gada Local Goverment Area for Sokoto state don cry out becos of di suffer wey dem dey suffer before dem get ordinary drinking water.
According to Mallam Jabir Ibrahim Yaro, wey wedipeople reach out to, after him post di mata for him X handle, come tori say di situation dey very critical as you can see for di video wey Mallam share give wedipeople.
Mallam Yaro wey dey try to see how him go take get help for dis Rafin Duma community, come tok say di situation critical sotey di people of di village dey even waka about 15 miles to Niger republic go fetch water.
Him tory say, according to wetin di people of di village tell him, dem dey spend almost about two weeks before di water go reach their turn, and upon dat dem nor dey even fit get 25 liters of water.
Mallam Jabir com ask di general public for assistance as dem dey try to see if dem go fit dig manual and solar borehole for dis community, since dis go go along way to help di people of dis community especially women and children.
Water dem say nai be life, e nor easy for women and children to dey go a whole 15 miles just to get drinking water for dis we great country.
Ballot box reach dat community during election, and di people vote, so we expect say by now ballot development suppose to don reach di community as di ballot box take enter there, so derefore, we go kontiniu to see if di people wey dis community people vote for, go manage bring hope of drinking clean water to dis Rafin Duma community. Also according to Mallam, many community dey around like dat wey lack ordinary water to drink.
In di meantime, while we dey wait say di representative of dat community go do sometin sharp sharp;
Mallam Jabir dey seek goodwill donations to dig dis borehole, so dat dis people, Nigerians for dat mata go see water dey drink, and if you like to donate through Mallam Jabir Ibrahim Yaro, you fit contact Mallam for +2348033200430 or im X handle @mallam_jabeer.
May God bless Nigeria
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.