Forget di Past

One of di easiest tin to do na to sidon, put your hand for your jaw, and begin to wallow for wetin don already pass.

Now, di reason why you nor suppose to at dis time put your hand for jaw and dey wallow over wetin don already pass, na becos say wetin don pass don already pass, and no amount of say you put your hand for your jaw go help gather any tablespoon of milk wey don already troway for ground.

Di best thing to do nah to try your best to forget about di past, nor just becos say na waste of your time and energy, but becos say e go good for your health to stop to dey worry over di past.

So as you start your day, tell your self say you go forget about di past becos e go good for your health especially your mental health.

Have a beautiful day.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment