People dey use mistake take kpai

Why we still dey fil di pain from wetin happen to actor Junior Pope, e dey remind person how people fit just kpai becos of mistake. E dey very possible say, if to say Junior Pope and oda people wey tanda for dat boat dat very day use life jacket, maybe dem for avoid dis kai kpai wey dem go kpai just like dat. E get rison why dem dey call am life jacket. Why we go always dey neglect so many important things for dis we kontri and begin…

AGN don suspend all feem shoot for today

Di presido of di Actors Guild of Nigeria (AGN) Emeka Rollas, don give command to all di feem people say make dem hold any feeming today, especially if di area dem wan use take feem na river area, becos of wetin happen to actor Junior Pope and others. Di presido of di feeming people com still giv anoda command wey ban other actors from any feem wey Adanma Luke go produce till further notice. Adanma Luke nai be get di production wey bi wan feature Junior pope and other crew…

Sanwon Olu say more buildings must demolish

Govnor of Lagos state, Babajide Sanwon-Olu, don tok say dem go nid to scatter more building for di dosumu market area, so dat dem go fit clean up due to di fire wahala wey happen. Sanwon Olu tori dis mata on Thursday wen im and some members of di executive visit di area. Di govnor announce earlier say, di market all round go close until dem finish di full assessment of how di fire take start. Sanwan Olu com further tori say, since people no like to do di right…

Alex Otti say im support Presido housing plan

Alex Otti wey be di govnor of Abia state don tori say im government go support presido Tinubu’s vision for di affordable houses wey im plan for Nigerians. Govnor Alex Otti tori dis one wen im receive di people of Federal Housing Authority wey di MD, Hon. Oyetunde Ojo carry com Abia state. Na dere Alex Otti tori further say, di vision of dat house mata dey in line with e own gworment, say im gworment don already site location to build diaspora village, so derefore im gworment go support…