Alex Otti say im support Presido housing plan

Alex Otti wey be di govnor of Abia state don tori say im government go support presido Tinubu’s vision for di affordable houses wey im plan for Nigerians.

Govnor Alex Otti tori dis one wen im receive di people of Federal Housing Authority wey di MD, Hon. Oyetunde Ojo carry com Abia state. Na dere Alex Otti tori further say, di vision of dat house mata dey in line with e own gworment, say im gworment don already site location to build diaspora village, so derefore im gworment go support di presido vision well well.

Hon. Oyetunde com join tori say in line with di renewed hope of Mr. presido nai make dem com sidon with Alex Otti di govnor, so dat at di end of di day, dem go gather design di kind of houses wey go favor Abia people.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment