Why we still dey fil di pain from wetin happen to actor Junior Pope, e dey remind person how people fit just kpai becos of mistake.
E dey very possible say, if to say Junior Pope and oda people wey tanda for dat boat dat very day use life jacket, maybe dem for avoid dis kai kpai wey dem go kpai just like dat.
E get rison why dem dey call am life jacket.
Why we go always dey neglect so many important things for dis we kontri and begin always tok say God dey, na question wey all of us go nid to answer.
We di people go tanda our eyes and ears to see which kai safety rules and regulations actors guild of Nigeria go put in place going forward, so dat anoda disaster like dis nor go happen again.
E dey pain well well say person just comot from house, hale and healthy and end up go kpai becos of say some people forget to do wetin dem suppose do.
Make di soul of dose wey kpai becos of dis negligence kontiniu to rest in peace.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.