Sanwon Olu say more buildings must demolish

Govnor of Lagos state, Babajide Sanwon-Olu, don tok say dem go nid to scatter more building for di dosumu market area, so dat dem go fit clean up due to di fire wahala wey happen.

Sanwon Olu tori dis mata on Thursday wen im and some members of di executive visit di area.

Di govnor announce earlier say, di market all round go close until dem finish di full assessment of how di fire take start.

Sanwan Olu com further tori say, since people no like to do di right tin, gworment nor go still look face to carry out their responsibility, according to di govnor, di fire disaster na wetin nor suppose happen in di first place, but people come decide to go convert their houses to warehouse, and dem com still go put materials wey dey catch fire inside, and di gworment nor go accept dis kind lawlessness, and dem go close di place no mata how long e go take to correct tins for dere, and na zero tolerance nai go be di approach going forward.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment