Di earlier wey we realize say na only one life nai we get, and dis one life no come get duplicate, di more careful all of us go like to do tins.
Prayers get e place, doing di right tin get e place, following rules and regulations get e place.
You nor go neglect di rules and regulations wey dem put for ground com tok for your mind say God dey, becos according to you, you don already pray.
E go com mean say you dey test God be dat, becos u go com dey ask God to support di fact say you nor do di right tin, and Him tok say na wetin we sow we go reap.
I know say di place of God’s mercies dey, but how about we just use di time wey we go take pray pray, and den follow di rules and regulations wey dem put for ground just to avoid wahala, just so dat di wahala and tori nor go come too long.
So as you start your day today and every oda day, make sure say you nor go join di people wey dey always tok say God dey and on top of saying God dey, dem nor go still do di right tin.
Abeg make all of we decide firmly say, no mata what, we must do di right tin
Have a beautiful day.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.