Electric don kpai one suspected thief wey be go thief electric cable for Benin City.
According to tori, di man wey dem never fit identify look like one middle age man, and na di cable wey dey one transformer wey belong to BEDC electricity nai di man be wan vandalize and carry run before di electric com shock am and kpai am.
Dis mata happen early mor mor on Tuesday April 16th along Airport road for Benin City.
Na dere Mrs Evelyn Gbiwen, wey be di Acting Head, Corporate Communications of BEDC Electricity Plc, com tori say, dem don dey too witness plenty vandalization of di company facilities around Edo, Delta, Ekiti, and Ondo, and upon say dem dey always dey warn people say na very dangerous tin to go vandalize electrical facilities, people still kontiniu to dey do am, and dis bad behavior dey kontiniu to make people wey dey pay for di light nor dey see di light.
Mrs. Evelyn com advise people wey dey around where BEDC see for get equipment make dem kontiniu to shine deir eye for those equipment, and also help save dem from vandals so dat dem BEDC go fit dey serve di community well well.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.