Federal government don start to share di N200 billion Presidential Conditional Grant Scheme to applicants wey dem don successfully verify.
Dis palliative loan na President Bola Tinubu’s administration idea wey dem wan take support business financially, and empower people to succeed for deir goals, dreams, aspiration and business.
Di Minister of Industry Trade and investment Dr Doris Anite com share update about dis good news for her X handle yesterday.
Dr. Doris com tok say some verified beneficiaries don already received grants wey mark di beginning of di disbursement, and by Friday April 19th dem go disburse give plenty applicants wey dem don already verify.
Di minister come further tori say dem go make sure say di process dey smooth and transparent as dem don work with telecommunication providers, and dis collaboration don remove di delays wey be dey regarding di receiving of shortcodes for NIN verification for people to continue di application.
Dr. Anite com ask make applicant patience, as dem go kontinu to process di application with due diligence and fairness, and every application go get di consideration accordingly.
And to access dis loan, dem say make individual apply for https://loan.fedgrantandloan.gov.ng
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.