Nigerian Navy don tori say dem don arrest about 75 people wey be wan japa comot from di kontri through di bottom of cargo ship, and dat na wetin oyibo dey call stoleaway. According to Commodore Adams Aliu, wey bi di Director of Naval information, dis attempt na criminal offence and e carry heavy consequences if dem catch you. Navy com warn say apart from say stoleaway na criminal offence and di heavy consequences wey e carry, stoleaway na very dangerous way to wan take japa, becos e fit lead…
Day: April 18, 2024
Lagos State Police don apologize say na mix up for DJ Switch
Lagos state police don apologize over di mix up wey dem be tori earlier regarding di arrest of DJ switch. Dem com tori say na mix-up, say na DJ Commissioner Wysei nai dem arrest and nor be DJ Switch.
FCCPC don go lock 4U supermarket
Di Federal Competition and Consumer Protection Commission, FCCPC, don put selotape for di ogbonge 4 U supermarket wey dey Wuse 2 for Abuja, becos say dem dey sell bag of rice wey nor correct and dem com dey hide beta information. Dis kind practice according to di acting executive vice chairman of di commission, Adamu Abdullahi, dey unacceptable, dat is to say di commission nor go gree for dis kind wayo practice. Di commsiison according to tori, com make sure say, base on how people take dey complain say, dollar…
EFCC don declare Yahaya Bello wanted
Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, on Thursday, April 18, 2024 com declare former govnor of Kogi State, Yahaya Adoza Bello wanted becos say im nor gree appear for court for im connection inside alleged money laundering wey reach N80.2 billion. Dis tori dey inside di EFCC website, and dem say anybody wey get information about di corner wey di former govnor dey, make di person contact di commission or di police station wey dey near dem.
Aisha Yesufu say if she bi presido, Kogi governor for nor try wetin im try yesterday for Abuja
Aisha Yesufu wey be human right activist, don tori for her X handle wey we first dey call twitter say, wetin happen yesterday between former governor of Kogi state Yahaya Bello and operatives from EFCC for nor happen imagine say she bi presido of Nigeria. Our current presido na Bola Ahmed Tinubu. Di human right activist com say, e bi like say she for nor gree for anybody, not even di current govnor of Kogi State, Usman Ododo wey tori carry say nai im com stop di arrest. EFCC be…
Abuja high court don troway di cyberbullying and criminal intimidation case against Ijele wey be blogger
Magistrate court for Abuja don troway di case of criminal intimidation, cyberbullying, threat to life, cyberstalking wey dem file against social media influencer Ofoegu Chukwuma wey we know as Ijele. Emmanuel Iyanna wey bi di chief Magistrate nai troway di case becos according to him di case lack jurisdiction. Di chief magistrate com tok say, becos no charge against Ijele for im court, dem fit go arraign Ijele wey be di defendant for federal high court wey di prosecution for first file di charges against am. Minwhile small drama bi…