Abuja high court don troway di cyberbullying and criminal intimidation case against Ijele wey be blogger

Magistrate court for Abuja don troway di case of criminal intimidation, cyberbullying, threat to life, cyberstalking wey dem file against social media influencer Ofoegu Chukwuma wey we know as Ijele.

Emmanuel Iyanna wey bi di chief Magistrate nai troway di case becos according to him di case lack jurisdiction.

Di chief magistrate com tok say, becos no charge against Ijele for im court, dem fit go arraign Ijele wey be di defendant for federal high court wey di prosecution for first file di charges against am.

Minwhile small drama bi com dey happen for around di court, as police people both di one wey wear uniform and wey no wear uniform com tanda to rearrest Ijele, but e be like say dem nor com succeed as di prison officials nor come gree.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment