Aisha Yesufu wey be human right activist, don tori for her X handle wey we first dey call twitter say, wetin happen yesterday between former governor of Kogi state Yahaya Bello and operatives from EFCC for nor happen imagine say she bi presido of Nigeria.
Our current presido na Bola Ahmed Tinubu.
Di human right activist com say, e bi like say she for nor gree for anybody, not even di current govnor of Kogi State, Usman Ododo wey tori carry say nai im com stop di arrest.
EFCC be dey find Yahaya Bello to com answer for di plenti borku money wey dem say e be like say dem choplate, wey oyibo dey call financial crimes.
See as Aisha Yesufu take tori am for her X handle

Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.