FCCPC don go lock 4U supermarket

Di Federal Competition and Consumer Protection Commission, FCCPC, don put selotape for di ogbonge 4 U supermarket wey dey Wuse 2 for Abuja, becos say dem dey sell bag of rice wey nor correct and dem com dey hide beta information.

Dis kind practice according to di acting executive vice chairman of di commission, Adamu Abdullahi, dey unacceptable, dat is to say di commission nor go gree for dis kind wayo practice.

Di commsiison according to tori, com make sure say, base on how people take dey complain say, dollar wey dem say make food prices go up, don come down, but food prices nor gree reduce for market, nai di commission make sure say dem visit plenty supermarkets for area to make sure say dem enforce price display and compliance.

According to wetin one anonymous tok, e com be like say na people nai com be di problem nor be dollar, di anonymous com tok say, people go just carry dey find over gain, all becos say dem wan show say dem beta pass deir neighbor.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment