Nigerian Navy don tori say dem don arrest about 75 people wey be wan japa comot from di kontri through di bottom of cargo ship, and dat na wetin oyibo dey call stoleaway.
According to Commodore Adams Aliu, wey bi di Director of Naval information, dis attempt na criminal offence and e carry heavy consequences if dem catch you.
Navy com warn say apart from say stoleaway na criminal offence and di heavy consequences wey e carry, stoleaway na very dangerous way to wan take japa, becos e fit lead to say di people wey stoleaway fit get serious injury and den go finally kpai.
Dem com further tory say stoleaway na illegal as dem state am clearly for di Convention on Facilitation of International Maritime Traffic (FAL Convention).
And between August 2023 to April 2024 dem don arrest about 75 stoleaways and don hand over dem give Nigeria Immigration Service (NIS) according to as di law talk am, so dat immigration go com take further action.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.