Dis conscience sef, na wetin e mean? conscience na dat feeling or dat voice wey dey inside you, and dey let you know say you don do bad tin or you don do good tin.
Di good tin be say, everybody for dis world get dis conscience, so dat nobody go fit lie give theirself, except say dat person don just decide to kpai im conscience finish.
Now, dis na wetin conscience dey do, if you bi bad person, conscience go let you know say bi bad person, if you be good person, conscience go also let you know say you bi good person, e come depend on you as you wan take respond wen your conscience like your mirror tell you exactly who you be.
The truth bi say, if all of us decide to use our conscience well, especially for dis our kontri, I dey very sure say everytin go good small. For example if politician use their conscience well, com say dem go use di money wey dem suppose to use for di good of di people, and really use am well for di good of di people, and use am for di good of di people mean say, dem nor go thief di money wey belong to citizens, and den people wey dey fight corruption go com start to dey pursue dem up and dan, you go see am say, tins go good and every body go start to cut deir clothes according to both di size and di cloth wey dem get get.
E nor go be just di politicians, if all of us decide say na from us nai d good and di bad tin dey start, but we choose to do di right tin, den everywhere go stew.
Today we all need to ask and check our sef very well weder our conscience still dey work.
Your day is blessed.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.