Nigerian Army don tori say dem don dismiss two soldiers wey bi Corporal Innocent Joseph and Lance Corporal Jacob Gani, sake of thief thief mata wey concern armoured cables for inside Dangote Refinery wey dey Lagos State.
Na Major General Onyema Nwachukwu, wey bi di spokesman for army nai tori dis one on monday, im com say dis thief thief mata happen on April 14 2024, and dem wan com update di people on how far dem don go with di investigation.
Major Onyema com tok say, after dem carry out beta investigations on top di mata , dem find out say di two soldiers abandon deir duty post begin do kurukere waka, before dem catch dem with di cables wey e nor suppose to dey deir hand. And becos of dat misconduct, dem com charge both of dem say dem fail to perform dier duty wey dey punishable under section 57, sub section (1) and Other Civil Offences punishable under section 114, sub section (1) of the Armed Forces Act CAP A20, the Law of the Federation of Nigeria 2004.
Im com further tori say dem try dem, and found dem guilty according to di military law, and becos of di zero tolerance wey Army get concerning any criminal mata, no mata who dey involve, d two soldiers are here dismissed from di Nigeria Army with immediate alacrity.
Im com tok say Nigeria Army go kontiniu to dey protect deir integrity and reputation.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.