One of our active citizens don com lament d yama yama state wey Okin biscuit factory com dey. Na active citizen Mayowa na share am for im X handle how dem take visit di abandoned factoy. Im com tok say na as dem dey com back from Ajasse Ipo for Kwara state, nai dem see di Okin biscuit factory and luckily for dem, dem allow dem enter just to see. Na dere dem shock to see di yama yama abandon state wey di factory com dey. Citizen Mayowa com tok…
Day: April 23, 2024
Stay Positive
Today I just wan encourage you, and di encouragement bi say, no mata wetin you dey go tru for anywhere you dey for dis world, I say make you just kontiniu to stay positive becos beta days go com. So, as you dey start your day, nor forget to always stay positive and expect say beta days dey com, becos, dat beta days go com. Have a beautiful day.
Former Presido don tell Current Presido make im add private university students join di student loan
Former Presido Olusegun Obasanjo don ask Presido Bola Tinubu to add students wey dey private universities join di students wey go benefit from di student loan scheme. Obasanjo com also tori say im dey very worried as how dem go take handle dis student loan scheme without corruption, and im com still agree say di student loan dey important becos e go help di development of di society, but e nor go good to remove students from private universities, and say im dey hope say di gworment go listen and…
INEC don publish di final list of di candidates for Edo state govnorship election
Independent National Electoral Commission don tory say dem dey happy to announce say dem don publication di final list of candidates wey go participate for di Edo State govnorship election. Dem say dem publication di personal particulars of di govnorship candidates and dier running mate for both di state and local gworment offices wey dey Edo State. Dem further tori say overall, na 17 political parties nai get candidates for di election wey go happen for September 21 2024, and inside dat 17 candidates, 16 na men while na only…