Former Presido don tell Current Presido make im add private university students join di student loan

Former Presido Olusegun Obasanjo don ask Presido Bola Tinubu to add students wey dey private universities join di students wey go benefit from di student loan scheme.

Obasanjo com also tori say im dey very worried as how dem go take handle dis student loan scheme without corruption, and im com still agree say di student loan dey important becos e go help di development of di society, but e nor go good to remove students from private universities, and say im dey hope say di gworment go listen and include di private student inside di student loan scheme.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment