Independent National Electoral Commission don tory say dem dey happy to announce say dem don publication di final list of candidates wey go participate for di Edo State govnorship election.
Dem say dem publication di personal particulars of di govnorship candidates and dier running mate for both di state and local gworment offices wey dey Edo State.
Dem further tori say overall, na 17 political parties nai get candidates for di election wey go happen for September 21 2024, and inside dat 17 candidates, 16 na men while na only 1 be woman. And di list com also carry di candidates dem deir age, di school and qualification wey dem get and if dem also get any disability.
Dem tori say all dis informate dey inside deir website and social media platform for di general public to see.
INEC com tori say as dem don publication di final list of candidate so, campaign fit com start on Wednesday April 24th 2024 and end for midnight on Thursday September 19th 2024, and dis na according to as di law tori am for Section 94(1) of the Electoral Act 2022, say campaign by political parties for public go only commence not earlier than 150 days before polling day and end 24 hours before election day.
Dem com advise di candidate and deir supporters to follow di rules of engagement especially di governing rules wey cover campaign, and one of such rules na to make sure say all political parties, deir candidates and supporters must not do any anythin wey go harm members of di public.
Di Edo state govnorship election go happen on Saturday September 21 2024.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.