Presido of United States, Joe Biden, don sign one bill enter law to ban TikTok app comot from social media for inside U.S. As dem pass di bill for congress, dem com say dem order di company ByteDance wey be like say na China company, to sell di app within nine months, or kuku face di ban from U.S. TikTok official com later release statement say, dem go challenge di mata for court, as dem say dat kind leg wey US presido carry come dey unconstitutional.
Day: April 24, 2024
Concerning di fire mata wey happen for Bini
Tori tok say fire don happen for mostly medical shops wey dey opposite university of Benin teaching hospital (UBTH). Dem say na one of di shop nai di fire for start before e com spread enter oda shops for dere, and as di fire start, both di federal fire service, di Edo state fire service, di Nigerian Army school of supply and transport Benin, di University of Benin fire service, and di University of Benin Teaching Hospital, UBTH, com try dier best to make sure say dem fit quench di…
One of our sister don rapa from UK back to naija say she don tire
One of our sister don share for her TikTok video wey bi nikkystar_55, say, she tire for United kingdom wey be UK, and decided to com back to naija after two years, dis one na wetin we go call rapa opposite of japa. Our sister say she don tire for di hussle hussle for Uk and finally decide to return to naija, she com still tori say nor be only she and her family, as plenti japaris dese days don dey com back to naija make dem com take advantage…
Peter Obi don reply Reno Omokri about di school mata
Mr. Peter Obi, wey bi di presidential candidates of Labour Party LP for di last general election wey happen for 2023, don com tori why im nor build new schools when im be govnor for Anambra State. Peter Obi tori dis one wen im hold one press conference on Wednesday for Abuja. Na dere Obi com reply Reno Omokri wey be social media influencer wey say im challenge anybody to show school wey di former govnor build for Anambra state di time wey im be govnor, Reno com say im…
EFCC say Former CBN govnor Emefiele use N18.9billion take print N684.5million
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don file new charge against former govnor of Central Bank of Nigeria Mr. Godwin Emefiele, sake of say im use N18.9billion take print N684.5million notes. Na for High court Abuja nai EFCC for file dis new charge against Godwin Emefiele, and com tok say na im approve make dem print N684,590,000 with N18.9billion. Dem com further tori for di charge say di former CBN govnor broke di law becos im purposely harm di people of Nigeria during di time of former president Buhari…
Gworment don suspend operation for Dana Air becos of safety mata
Nigeria gworment don suspend commercial activities for Dana Airline becos of safety concerns, and na on Wednesday nai gworment direct di management of di airline to suspend deir commercial operations. Na di minister of Aviation, Festus Keyamo nai giv dis direction becos of di mata wey happen with di airline for Murtala Muhammad Airport, Lagos State on Tuesday. Remember say d airline be run comot from di Murtala Mohammed airport runway on Tuesday, although say people nor injure, but di general public dey ask questions about di safety mata concerning…
Jamb don arrest one papa wey go write exam for im pikin
Di Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) don tori say, dem don arrest one man and im pikin becos say di papa go write JAMB-UTME exam for im pikin, wey oyibo dey call exam malpractice. Jamb nor mention di name of di papa and im pikin, but dem tori say di papa commit di offence when di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) dey go on. Na Prof. Ishaq Oloyede, wey bi di Jamb registrar, nai tori dis one when im dey inspect di UTME centres for Kaduna on Wednesday. Im…
A reminder say na empty hand we carry com
E get why God di creator allow everybodi com dis world empty, and nobody go fit question God Almighty why Him do am like dat. But dese days, common sense go don tell us why Him do am like dat especially with wetin dey happen now for our kontri. Now, take one minute and imagine if to say God allow us carry everytin wey we as human being dey like enter dis world, and com also tok say, as we dey comot from dis world we go carry everytin wey…