Concerning di fire mata wey happen for Bini

Tori tok say fire don happen for mostly medical shops wey dey opposite university of Benin teaching hospital (UBTH).

Dem say na one of di shop nai di fire for start before e com spread enter oda shops for dere, and as di fire start, both di federal fire service, di Edo state fire service, di Nigerian Army school of supply and transport Benin, di University of Benin fire service, and di University of Benin Teaching Hospital, UBTH, com try dier best to make sure say dem fit quench di fire.

Most of di traders don dey lament say dem don loose their goods wey reach millions of naira for inside di fire.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment