Gworment don suspend operation for Dana Air becos of safety mata

Nigeria gworment don suspend commercial activities for Dana Airline becos of safety concerns, and na on Wednesday nai gworment direct di management of di airline to suspend deir commercial operations.

Na di minister of Aviation, Festus Keyamo nai giv dis direction becos of di mata wey happen with di airline for Murtala Muhammad Airport, Lagos State on Tuesday.

Remember say d airline be run comot from di Murtala Mohammed airport runway on Tuesday, although say people nor injure, but di general public dey ask questions about di safety mata concerning di airline.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment