Mr. Peter Obi, wey bi di presidential candidates of Labour Party LP for di last general election wey happen for 2023, don com tori why im nor build new schools when im be govnor for Anambra State.
Peter Obi tori dis one wen im hold one press conference on Wednesday for Abuja.
Na dere Obi com reply Reno Omokri wey be social media influencer wey say im challenge anybody to show school wey di former govnor build for Anambra state di time wey im be govnor, Reno com say im go give anybody $10,000 wey go show any school wey Peter Obi build.
Na dere Obi com tori say, wen im resume as govnor, he meet schools wey yaput for ground, and di school system wey scata everywhere, nai im com decide to improve di quality, physical and mental well-being of di people and repair dose schools wey yaput, and to do dis, im com provide all di basic things wey di school nid, and becos dem com get all di basic tins wey dem nid, di people especially di students com shine like stars and dat na exactly wetin im get for im manifesto.
Obi com tori further say, becos of dat step wey im take, Anambra state com rise to di top from di 26th position wey dem bi dey for di nation dat time.
Peter Obi com still tok say, na becos say people wey dey claim say im nor build school nor take di time to go read im manifesto, plus say to build new school sef dat time wen all di old ones don yaput scata finish go be like wen dem wan build coastal lines wen all d old road for we nation dey cry for help.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.