Tinubu don approve N100billion as consumer credit for Nigerians

President Bola Tinubu don approve make dem start di N100 billion consumer credit scheme for Nigerians becos of di economic hardship wey dey kontri.

Na Ajuri Ngelale, wey bi di spokesperson to presido nai tori dis one on Wednesday. Im com tok say any Nigerians wey dey interested fit visit di portal of Nigerian consumer credit corporation before May 15, 2024.

dis na di portal wey di spokesperson say make working Nigerians visit if dem dey interested.

“Working Nigerians interested in receiving consumer credit can visit www.credicorp.ng to express interest. The deadline is May 15, 2024.”

Im com tori further say di scheme dey in phases, and na people wey dey civil service nai dem go first attend to before e go reach di general public.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment