Naira don appreciate small after e bi don dey depreciate for where di dollar bi dey since days now. And e appreciate as at Friday morning from $1380 to $1300 for parallel market.
Day: April 27, 2024
Zulu Adigwe
Ogbonge Nigeria Nollywood actor Zulu Adigwe don kpai, and na April 23rd 2024 nai im kpai. Zulu Adigwe na beta ogbonge actor for wi nollywood wey dey like to play papa roll very well. We say make im soul continue to rest in peace.
Di pastor say na becos say im fast for 21 days nai make di world no end again on April 25th
One pastor wey tok say di world go end on April 25th, don com tori again say na becos say im fast for 21 days nai make God giv di world pardon. Wetin di pastor mean be say na im fasting and prayer for 21 days nai make God say im don pardon di world. But some public opinion bi dey ask say where di man for see God. See as yabaleftonline take tori am for deir X handle.
One of our broda wey japa go UK with e family don kpai e wife
One court for United Kingdom don hold one of our broda wey im name bi Olubunmi Abodunde, wey dey 48 years old, sake of say im kpai e wife becos say im dey suspect say e wife dey go do away match wey oyibo dey call extra marital affair. Tori tok am say na year 2022 nai di man japa go UK with im wife and three pikins. Dem further tori say di man and im wife dey always dey get argument about away match and plenti plenti bills for…
Dem don arrest some chinese pipo wey dey do illegal mining for Nasarawa
Ogbonge security pipo from di mining marshalls of di Nigerian Security and Civil Defence Corps (NSCDC) don arrest four chinco pipo becos of illegal mining wey dem dey do for Nasarawa State. Nor forger say illegal mining don carry Nigeria as a kontri go back well well, as dese illegal miners go mine finish, dem nor go pay any tax to our gworment or even say make dem repair di community wey dem for dey do di illegal mining, but dem go scata everywhere finish, and den carri di plenty…
American international suku say dem don return di aduvance fees wey Yahaya Bello pay for im children
Di American international suku wey dey Abuja, where former guvnor Yahaya Bello for go pay aduvance fees for im children don return $760,910 to EFCC. Na di head of di suku Greg Hughes, nai tori dis one on Saturday, say di suku nor get nortin to hide for di mata, say dem agree say dem collect di aduvance fee, but as dem com learn say di aduvance fee dey in connection with di mata wey EFCC dey investigate, dem begin cooperate with EFCC and com return di amount to EFCC.…
Dem don carry di first electric bus com out for Oyo State
Engineer Dotun Sanusi wey also be Ibadan business man don carry electric bus com out, dis go make am di first electric bus and na 100 seater di bus bi. Engineer Dotun com tori as im dey launch di electric bus say make di okada people and people wey dey ride keke nor worry, becos dem go soon get di opportunity wey go help dem change from diesel or petrol to electric.
Lagos state gworment don tori say Sanwo-Olu nor talk say new minimum wage na N70K
Lagos State gworment don tori say e nor get di time wey govnor Babajide Sanwo-Olu take tok say im don increase minimum wage to N70,000. Na Lagos state commissioner for information nai tori dis one say, di tori wey dey out dere say guvnor Sanwo- Olu increase minimum wage nor correct, say di guvnor only tori say since January, civil servants don dey earn N35,000 as wage award wey federal gworment say make workers dey reciv, and if you add dat N35,000 wage award join di N35,000 wey civil servants…
New minimum wage for workers fit nor happen on May 1st
Presido of Trade Union Congress of Nigeria (TUC) Mr. Festus Osifo, don tori say, di new minimum wage wey every worker tanda and dey scratch ear dey wait for fit nor happen on May 1st. Festus Osifo tori dis mata for Abuja as im dey address newsmen, im com say, di reason why di new minimum wage nor go fit ready on May 1st na becos say di committee wey sidon on top di mata of di increase still dey do deir work and im believe say soon all of…
Tinubu don appoint Jim Ovia as chairman of Nigeria Education Loan Fund
Presido of Nigeria, Bola Tinubu, don appoint Mr. Jim Ovia as di new chairman wey go head di board of di Nigerian Education Loan Fund (NELFUND). Jim Ovia na ogbonge better banker and better business man, and na Friday nai presido appoint am, as Ajuri Ngelale wey bi di special adviser to presido on media and publicity mata take announce am. Presido tori say, di education loan fund need person wey be professional and com get experience join, and im believe say Jim ovia go use e experience and professionalism…