Dem don arrest some chinese pipo wey dey do illegal mining for Nasarawa

Ogbonge security pipo from di mining marshalls of di Nigerian Security and Civil Defence Corps (NSCDC) don arrest four chinco pipo becos of illegal mining wey dem dey do for Nasarawa State.

Nor forger say illegal mining don carry Nigeria as a kontri go back well well, as dese illegal miners go mine finish, dem nor go pay any tax to our gworment or even say make dem repair di community wey dem for dey do di illegal mining, but dem go scata everywhere finish, and den carri di plenty resources wey God put for wi land to better wi land and wi pipo comot just like dat without any consequences, except say now wey we dey hear say dem don arrest four of dese chinco pipo, and na for Karu local gworment area where dem for dem dey mine lithium illegally and even sell am, dem for catch dem.

Di public relations officer NSCDC, Babawale Afolabi, com tori further say, dem arrest di four chinco pipo for di illegal lithium site were dem for dey sell am for di Karu area, and after investigation from deir operation di chinco pipo com agree say na dem dey operate di illegal site wey dem dey use take dey sell di lithium.

Na dere nai John Onoja wey be di mining marshall commander com tori say dem go carri di mata go court so dat dem go fit seize di lithium and di money from di lithium go enter federal gworment account.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment