Lagos State gworment don tori say e nor get di time wey govnor Babajide Sanwo-Olu take tok say im don increase minimum wage to N70,000.
Na Lagos state commissioner for information nai tori dis one say, di tori wey dey out dere say guvnor Sanwo- Olu increase minimum wage nor correct, say di guvnor only tori say since January, civil servants don dey earn N35,000 as wage award wey federal gworment say make workers dey reciv, and if you add dat N35,000 wage award join di N35,000 wey civil servants dey reciv before di wage award, e mean say dem com dey reciv N70,000.
Im com further tori say di guvnor only tok say by di grace of God everybody go soon see di new minimum wage wey federal gworment get for mind for workers.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.