Pst Kumuyi wey be di general superintendent of Deeper Life Bible Church, don advise our youth to be agent of change and remove hand from any mago mago as dem dey waka thru dis life. Di pastor com tok say make youth always try to run away from things wey nor good for dia destiny and practice godly lifestyle and also stay focus. Na for one youth program wey dem hold for Aba Abia state na Pst Kumuyi for giv youth dis advise.
Day: April 28, 2024
Nigerians for South Africa don cry out say dem dey expolit dem becos of NIN enrolment
Di Nigerian Citizens Association South Africa, West Cape, NICASA WC, wey bi di bodi wey gworment recognized for South Africa don tori say, di exploitation wey dem dey face sake of say dem wan enrol for NIN don too much. Na di Chairman of NICASA, Apostle Henry Ezumaha, and Leo Azebeokhai di Deputy Chairman, for Western Cape Province, nai tori dis mata concerning di yeye wey Nigerians dey reciv on top dis enrolment process of NIN. Dem com tori say di third party wey dey involve for di enrolment mata…
Di power of organized community
One tin wey I see for one of di abroad wey I travel go one certain time like dat, na say, I see as dia gworment for dat particular kontri take take advantage of di community, and use di people of evry community take better dia community and eventually di whole of dia kontri.. And e com happen say as dem dey beta di community dey go, I com dey surprise say evrybodi for di community use style know each oda, dem dey know when stranger enter di community, and…
Love your neighbor
Who be your neighbor? Dictionary define neighbor as person or pipo wey dey stay close to you. But for dis post today, we go take neighbor as dat good samaritan wey see say one oda person don almost kpai from di beat wey unknown mengun beat am as e dey travel for one lonely road, and as dis good samaritan see say dis person dey ground with plenty injury, im com decide to com down from im horse to help dis person wey im nor know before and carry di…