Who be your neighbor? Dictionary define neighbor as person or pipo wey dey stay close to you.
But for dis post today, we go take neighbor as dat good samaritan wey see say one oda person don almost kpai from di beat wey unknown mengun beat am as e dey travel for one lonely road, and as dis good samaritan see say dis person dey ground with plenty injury, im com decide to com down from im horse to help dis person wey im nor know before and carry di person go treat am.
In odawords, your neighbor nor bi just di person wey dey stay close to you, but evry one person you com across as you dey joni thru dis life suppose bi your neighbor, and you suppose to love dat person as you take love yoursef.
I beliv say if all of us carry dis mentality of say evry body for dis world wey we dey so na our neighbor wey we supose to love as we love oursef, maybe bad tins nor go too plenti, since you nor go open eye to see say bad tin happen to your bodi, and as you nor go open eye to see say bad tin happen to your bodi becos say you love your bodi well well, na so you nor go still open eye to see say bad tin happen to your neighbor.
And as you dey start your day, nor forget to ask yoursef weder you bi beta neighbor, and if your answer na yes, I say make you kontiniu, if your answer na no, e never late for you to start to love your neighbor as yoursef.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.