Di Nigerian Citizens Association South Africa, West Cape, NICASA WC, wey bi di bodi wey gworment recognized for South Africa don tori say, di exploitation wey dem dey face sake of say dem wan enrol for NIN don too much.
Na di Chairman of NICASA, Apostle Henry Ezumaha, and Leo Azebeokhai di Deputy Chairman, for Western Cape Province, nai tori dis mata concerning di yeye wey Nigerians dey reciv on top dis enrolment process of NIN.
Dem com tori say di third party wey dey involve for di enrolment mata dey discriminate against Nigerians, plus many oda yeye tins wey dem do , and dis na ontop say dem go still dey charge big money, di association com say dem nor see any rison why any Nigerian go dey travel very far or even take flight to go do NIN for wetin dem suppose get for evry province for south Africa.
Na dere dem come call on Nigeria gworment to do something about dis yeye way dem take dey treat Nigerians becos of NIN mata, and also ask di Nigeria consulate for South Africa to help investigate any mata of discrimination and exploitation.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.