Army don catch one human trafficker for Lagos com rescue 22 years old victim

Nigerian Army don tori say dem don arrest one Mrs. Olushola Areke wey bi confirm human trafficker for Lagos State.

Di Army statement on Monday tori say “Mrs. Olushola wey be di suspect, kidnap one Miss Fayoke Kunle 22 years old girl pikin of one Mrs Ainor Kunle, di tori say Mrs Kunle bi handover her pikin giv Olushola becos say she promise to help Fayoke di 22 years old pikin find work for Oshodi area.

Tori com kontiniu say, instead of Olushola to find di work as she promise di pikin mama, she com carry Fayoke di 22 years old girl to Kano state and bi wan carry her go Libya.

Fayoke di victim com say na dere she for hear say pipo dey discuss as dem wan take transport her go Libya, nai she find as she go take escape, and she com finally fit run comot from Kano and come back to Lagos on April 23rd 2024.

Na dere Army say as dem here di mata, dem com reach out to di suspect Mrs. Olushola and com arrest her, and according to di tori, she bi believe say she be wan com carry another victim wey she go traffic. Army say Olushola di suspect and di victim don already dey police hand for Ajah so dat dem go investigate di mata further.

Army com later appeal to pipo say make dem dey cooperate with dem and report any mata wey dem nor understand on time.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment