Court don stop Multi Choice make dem nor increase price of DStv and GOtv

Di three-member panel of di Competition and Consumer Protection Tribunal (CCPT) wey dey Abuja don give one order say make Multichoice nor increase di price of DStv and GOtv wey dem be plan, and na Saratu Shafii nai com give dis order on Monday.

Dis new development dey happen after one Festus Onifade carry di mata of Multichoice increment go di consumer court.

Na dere di court give order say make Multichoice nor do any increase until di court go finally decide on di mata.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment