NANS say dem go protest if di fuel scarcity kontiniu

National Association of Nigerian Students (NANS) don tori say dem go start mass protest if gworment nor do everythin to take address di on going fuel scarcity for almost everywhia for di kontry right now.

NANS com still tori say if Mr. Mele Kyari wey bi di oga kpata kpata for di Nigerian National Petroleum Company Limited wey be NNPCL nor fit take actions to solve di fuel scarcity mata, make im kuku resign.

Na di Senate President for di association Babatunde Akinteye, nai tori dis mata on Monday say, di fuel scarcity dey cos serious hardship for students and Nigerians in general, as di scarcity don make transport fare go up, couple with every oda tins wey Nigerians dey struggle with right now including di electricity wey dem just increase and nor nor be bi say Nigerians kuku dey see di light use.

Akinteye com tok say dem go carry student enter street to protest if dis hardship wey di fuel scarcity dey cos so kontiniu, and com advise make NNPCL do wetin dem suppose to do.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment