As we dey joni for dis life, we go meet all mana, old, young poor rich good bad ugly peaceful troublemaker, evry borkus dem.
Di good tin be say, all of dis put togeda, nai make dis life bi dis life, and di rison why you nor suppose to take anytin or anybody for granted be say, you never can tell who go rescue you wen some kai tori start to get tail sometimes.
Sometimes sef na di person wey you dey use one kai eye take dey look say e bad well well, nai go later com rescue you.
So learn not to take anytin or anybody for granted as you dey joni dey com small small.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.