Police don arrest 16 suspects for Rivers ontop di female police officer wey dem beat and kpai

Rivers state police don arrest almost 16 pipo sake of say dem beat and kpai one christiana Erekere wey be police inspector.

Dem say dis mata happen on April 25th as Christiana Erekere bi dey duty dat day before di beating mata wey result to her kpaing, and na for front of Taabaa Police Station wey dey Khanna local government area of Rivers State e for happen.

Tori tok further say, na as Christiana bi stop some pipo for di normal routine checking, nai argument com start, and before you know wetin dey happen, di pipo com block di road say dem nor go comot becos say dem beliv say Christiana record dem with her mobile phone, na so dem say di pipo com start to dey drag di phone for Christiana hand and com go use heavy stone take hit her.

As dem hit Christiana with di stone, na dere she for com fall, com belike say she nor com fit stand up, before dem com rush her go Nnadum Hospital for Bori where she com finally com kpai becos of di injury wey di stone wey dem take hit her cos.

Di Rivers state police command com tok say dem dey investigate di mata dey com and dem go make sure say dem catch everybody wey dia hand dey inside dis mata wey Christiana Erekere take kpai so.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment