Dem don go scata di security post wey bi dey di private house of former deputy govnor of Edo state Philip Shaibu. Remember say na around last week nai dem impeach Philip Shaibu as deputy govnor. According to tori, na some policemen and di Edo security network nai com demolish di security post with bulldozer on Sunday evening.
Month: April 2024
Electric shock don kpai one man wey be wan thief cable for Benin City
Electric don kpai one suspected thief wey be go thief electric cable for Benin City. According to tori, di man wey dem never fit identify look like one middle age man, and na di cable wey dey one transformer wey belong to BEDC electricity nai di man be wan vandalize and carry run before di electric com shock am and kpai am. Dis mata happen early mor mor on Tuesday April 16th along Airport road for Benin City. Na dere Mrs Evelyn Gbiwen, wey be di Acting Head, Corporate Communications…
FG don start to share di presidential palliative loan give Nigerians
Federal government don start to share di N200 billion Presidential Conditional Grant Scheme to applicants wey dem don successfully verify. Dis palliative loan na President Bola Tinubu’s administration idea wey dem wan take support business financially, and empower people to succeed for deir goals, dreams, aspiration and business. Di Minister of Industry Trade and investment Dr Doris Anite com share update about dis good news for her X handle yesterday. Dr. Doris com tok say some verified beneficiaries don already received grants wey mark di beginning of di disbursement, and…
EFFC don charge Cubana Chief Priest for naira abuse
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don charge popular Nigerian Instagram celebrity Pascal Okechukwu, wey we know as Cubana Chief Priest for Naira abuse. Di gworment Agency charge Cubana Chief Priest becos according to dem, im spray, abuse and tamper with di national currency Naira for different party, and dis dey against di Central Bank Act of 2007, and according to EFFC na Wednesday, April 17th dem go arraign Cubana before Justice Kehinde Ogundare for Federal High Court wey dey Lagos.
CAPPA wey be PAN AFRICAN group don warn Nigerians and others over di vape cigarette wey Burna Boy company dey try distribute
Di Corporate Accountability and Public Participation of Africa (CAPPA) don condemn di five-year deal wey dey between Burna Boy company, BrkFst, and Aspire North America, LLC, wey be subsidiary of Inspire Technology Inc. According to how dem tori am for deir website, dis deal na for Burna Boy company BrkFst, to manufacture and distribute vaping products for Nigeria, Ghana, South Africa, and Europe. According to di CAPPA executive director Akinbode Oluwafemi wey tori say, dem nor go gree for di deal becos say na strategy from tobacco companies to use…
TC Okafor don tok say na lack of experience nai cause di boat accident wey Junior Pope for kpai
Actor TC Okafor wey be one of di person wey survive for di boat accident wey kpai Junior Pope, don tok say na experience wey di boat driver no get, nai cause di accident. Di actor and skit maker wey don already tok say from now on, im go only focus on e comedy career, com narrate how di accident take happen. TC tori say na only di director and DOP of di supposed feem location wey dem bin dey go, nai wear life jacket, and as di boat dey…
Rivers govt don tori say dem go support federal gworment for di housing plan
Rivers state govnor Sir Siminalayi Fubara don tok say im administration go support di housing plan wey federal gworment get for Nigerians. Sir Fubara tori dis one on Wednesday as im reciv di MD of federal housing authority Hon. Oyetunde Ojo and e team. Di govnor com further tori say dis housing project wey federal gworment plan, go reduce di housing challenge wey both low and medium income earners dey face for di country, and di plan dey in line with deir own plan as dem don plan on how…
NANS say dem support Air Peace
Di National Association of Nigerian student (NANS) don tori say dem support Air peace, becos dem see am say Air Peace na national asset and achievement wey go promote economic growth. Na di NANS senate president, comrade Akinteye Babatunde nai tori dis mata on how the change wey Air Peace bring com di market don take help di average Nigerians. Di comrade com further tori say make Nigerians do everytin to rally round and make sure say Air Peace succeed.
After all said and done, na only one life we get, so take care of yourself
Di earlier wey we realize say na only one life nai we get, and dis one life no come get duplicate, di more careful all of us go like to do tins. Prayers get e place, doing di right tin get e place, following rules and regulations get e place. You nor go neglect di rules and regulations wey dem put for ground com tok for your mind say God dey, becos according to you, you don already pray. E go com mean say you dey test God be dat,…
Sokoto state don announce Friday as work free day
Sokoto state gworment don declare today Friday April 12th as work free day. Na Abubakar Bawa wey bi di chief press secretary to di state govnor, nai tori dis mata yesterday. Im tori say di purpose of dis work free day na to help civil servant celebrate di holiday with their families becos of di Eid-el-Fitr celebration.