Why we still dey fil di pain from wetin happen to actor Junior Pope, e dey remind person how people fit just kpai becos of mistake. E dey very possible say, if to say Junior Pope and oda people wey tanda for dat boat dat very day use life jacket, maybe dem for avoid dis kai kpai wey dem go kpai just like dat. E get rison why dem dey call am life jacket. Why we go always dey neglect so many important things for dis we kontri and begin…
Month: April 2024
AGN don suspend all feem shoot for today
Di presido of di Actors Guild of Nigeria (AGN) Emeka Rollas, don give command to all di feem people say make dem hold any feeming today, especially if di area dem wan use take feem na river area, becos of wetin happen to actor Junior Pope and others. Di presido of di feeming people com still giv anoda command wey ban other actors from any feem wey Adanma Luke go produce till further notice. Adanma Luke nai be get di production wey bi wan feature Junior pope and other crew…
Sanwon Olu say more buildings must demolish
Govnor of Lagos state, Babajide Sanwon-Olu, don tok say dem go nid to scatter more building for di dosumu market area, so dat dem go fit clean up due to di fire wahala wey happen. Sanwon Olu tori dis mata on Thursday wen im and some members of di executive visit di area. Di govnor announce earlier say, di market all round go close until dem finish di full assessment of how di fire take start. Sanwan Olu com further tori say, since people no like to do di right…
Alex Otti say im support Presido housing plan
Alex Otti wey be di govnor of Abia state don tori say im government go support presido Tinubu’s vision for di affordable houses wey im plan for Nigerians. Govnor Alex Otti tori dis one wen im receive di people of Federal Housing Authority wey di MD, Hon. Oyetunde Ojo carry com Abia state. Na dere Alex Otti tori further say, di vision of dat house mata dey in line with e own gworment, say im gworment don already site location to build diaspora village, so derefore im gworment go support…
Eid Mubarak to all our muslim brothers and sisters
From all of us here at wedipeople, we say Eid Mubarak to all of our Muslim brothers and sisters. We say make we kontiniu to use dis period to pray for our dear country Nigeria, becos after all said and done, God is great and good, and He will show Nigeria His goodness. God bless Nigeria
Di people of Rafin Duma village need ballot box development
Di people of Rafin Duma village for Gada Local Goverment Area for Sokoto state don cry out becos of di suffer wey dem dey suffer before dem get ordinary drinking water. According to Mallam Jabir Ibrahim Yaro, wey wedipeople reach out to, after him post di mata for him X handle, come tori say di situation dey very critical as you can see for di video wey Mallam share give wedipeople. Mallam Yaro wey dey try to see how him go take get help for dis Rafin Duma community, come…
Wetin dey happen for cooking gas lane
Di price of cooking gas wey dem still dey call liquefied petroleum gas, LPG, don increase from N10,323 to N14,150 for 12.5kg cyclinder. Dem still dey maintain say na di increase of foreign exchange nai make di price go up like that. But most of we di people don complain say, dem don already start to dey use fire wood as e be say dem nor get money to buy gas becos of di increase.
Forget di Past
One of di easiest tin to do na to sidon, put your hand for your jaw, and begin to wallow for wetin don already pass. Now, di reason why you nor suppose to at dis time put your hand for jaw and dey wallow over wetin don already pass, na becos say wetin don pass don already pass, and no amount of say you put your hand for your jaw go help gather any tablespoon of milk wey don already troway for ground. Di best thing to do nah to…
President Tinubu don set up programme wey go track performance and accountability for health sector
President Bola Tinubu don approve make dem establish di national health fellows programme wey go carry young people along and engage dem for all di 774 local government areas wey dey di country. Na Ajuri Ngelale, wey be di special adviser for media and publicity to presido nai tory dis mata on Monday, him tok say dem establish di programme and engagement with di focus to upgrade service delivery for all di 8,800 primary health care centers wey dey round council areas for di country. Ngelale com further tori say…
Philip Shaibu vows to fight on
Philip Shaibu wey di state house of assembly just impeached on Monday as deputy governor don vow to fight on. Philip com describe di impeachment as illegal and witch hunting, say nah because of di ambition wey him get to contest di governorship election of di state under di People Democratic Party (PDP) nai make dem cook up allegations against him, and him go fight di impeachment. Shaibu com tok say di illegal impeachment as im describe am na heavy blow to democracy and di rule of law. Di former…