Godwin Obaseki wey be governor of Edo state don pick Omobayo Godwins as him deputy after di state house of assembly impeach Philip Shaibu. Di chief Judge, Justice Daniel Iyobosa Okungbowa nai swear Omoboya in as deputy governor on Monday. Remember say dem impeach Philip Shaibu on di grounds of misconduct say him commit perjury base on say he allegedly leak government secret.
Month: April 2024
Edo state house of Assembly don impeach deputy governor Philip Shaibu
Edo state house of assembly don finally impeach Philip Shaibu wey be di deputy governor of di state. Di house of assembly com impeach di deputy governor on Monday after dem adopt di report of di seven member probe panel wey dem set up to probe di allegation of gross misconduct against Philip Shaibu di deputy governor. Di assembly com tok say Philip Shaibu offence dey impeachable as dem accuse am say him commit perjury due to say him leak state government secret.
What are your daily thoughts
I just wan remind you say thoughts dey very powerful, nai make every of your thoughts, negative or positive get di way e take dey shape your life. But di good thing be say, no mata how your thoughts dey go, meaning if you dey always dey think negative thoughts, dis na di time to change and if you dey on di lane of always thinking positively, kotiniu to improve on that positive thoughts even when you think say you never see results. As you start your day, take time…
Follow your dream
Dis dream, wetin e be sef? Dream get many features or definition, but most importantly we fit define dream as that aspiration, that ambition or that idea wey you dey cherish well well, so that your aspiration, ambition and that idea wey you dey always think about fit turn out to be di dream wey nature bless you with as you dey come dis world. Now di question be say, why e be say most of us nor dey follow our dream? According to di late Dr. Myles Munroe, him…
4.8 Earthquake don happen for New Jersey and around New York
4.8 earthquake don happen for New Jersey and some areas around New York, and na friday morning dis one happen. According to report, dem no record any damage or injuries, but officials say dem still dey access di situation for any damage.
No more searching of citizen’s phone- Nigerian Police
Di Edo state command of di Nigeria Police don ban officers wey dey on patrol routine from searching of we di people, citizens phones. Na di state police spokesman SP Chidi Nwabuzor nai tori dis banning tori for di statement wey him issued on Friday. According to SP Chidi, wey tori say di Edo state commissioner of police, CP Funsho Adegboye, don advise officers and other men to stop to dey search citizen’s phones going forward, and dis instruction dey com from di inspector general of police, IGP Kayode Egbetokun.…
What are you doing with your time
Seconds nai dey turn to minutes and minutes go turn to hours while hours go eventually become full day, nai make am be twenty four hours make one day. Now di question be say, wetin you dey do with your seconds, your minute, your hours, and eventually your time?. For some of us, di time dey do tik tok without anything to show for am, for some we dey wait for di perfect time before we take any steps towards wetin we plan to do for life; but di good…
Dem say many Nigerians dey homeless for japa yonda
Most Nigerians, especially men don homeless for Dublin. Dis na according to one video wey instablog share for their X handle as you dey see am so.
Tinubu don sign student loan amendment bill into law
President Bola Tinubu don sign di student loans wey be (Access to Higher Education) Act (Repeal and Re-Enactment) Bill, 2024, into law. Dis na after di senate don finish to debate on di bill. Di purpose for dis bill na to give poor Nigerians access to higher education through interest-free loans from di Nigerian Education Loan Fund, wey the Act established to make sure say every Nigeria no mata your background fit afford to go school. But public opinion com tori say di pudding dey inside di choplation, and we…
President Tinubu say inflation go com down
President Tinubu don assure we di people say di economy don dey breathe small small and inflation go come down very soon. Presido yarn dis tory when him dey address di members of di presidential campaign council of di All progressive congress(APC) for state house banquet hall for Abuja. Presido com tori more say, him know say e job hard nor be small, and nor be magic to fix di issues wey dey confront Nigeria, but since him campaign promise Nigeria good result, him go continue to work to fulfill…