Di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don tori say, dem nor get hand for dat tori wey dey fly everywhere say dem dey investigate former 58 gwornos for kworuption wey reach N2.187trillion. Na Mr. Dele Oyewale wey bi di head of media and publicity, nai tori dis one on Sunday, im tok say di commission nor get hand for dat alleged investigation tori, and make di general public ignore dat kind tori since e nor dey com from dem.
Month: May 2024
Some Area for Edo and Delta state nor go see light for two weeks according to TCN
Di Transmission Company of Nigeria (TCN) don tori say light nor go dey for dia Amukpe substation for two weeks. Dem tori say di outage na to help contractors get environment wey dey safe as dem wan put two 132KV transmission tower for Amukpe substation. And becos of dis development, some communities for Edo and Delta state go face blackout for two weeks, becos say power supply nor go too much to Benin DisCo from Adeje industrial, woodland, Mosogar, Sapele and Abraka feeders during dis period wey contractors wan take…
Remove negative thinking from your mind
God give human being di most powerful weapon as Him dey create us com dis life, and Him come use Him infinite wisdom take put dat weapon inside us. Dat weapon if you ask me, na your mind. If you know di power wey your mind carry, you go dey guide your mind with everythin wey you get, especially to guide am from negative/bad thinking. But before your mind go become dat powerful weapon wey you fit take change anytin, you go nid to train your mind well well, and…
FG don declare today May 01 as holiday
Happy workers day as federal gworment don declare today May 01 2024 as holiday, so dat workers go see chance take celebrate. Na di minister of interior Dr. Olubunmi Tunji-Ojo, nai tori dis mata wey di Permanent Secretary, Dr. Aishetu Gogo Ndayako sign on Tuesday for Abuja.
Nigerians say na social media, laziness plus hunger nai make Jamb result poor well well
Nigerians don tori say na too much social media, laziness plus di hungry wey dey land nai make student wey sidon write Jamb dis year nor pass well. According to di response to one post wey Tribune online do, Nigerians com tori say, e dey very bad say out of 1,989,668 students wey Jamb say register and sidon for di exam, a whole 1,402,470 com get score wey dey below 200. Some pipo com still tori say, students dese days nor wan study, say majority of dem na just to…
Osun state gwornor Adeleke say im neva borrow any moni since im resume office
Gwornor of Osun state, Ademola Adeleke, don tori say im never borrow any moni since when im become gwornor of di state. Di gwornor tori dis one wey im dey give di pipo report of e stewardship for di second edition of dia ipade imole forum. Gwornor Adeleke com tok say di rison wey im never boro any kobo bi say, di plan dey among di plan and di pledge wey im make, say im nor go boro moni, but im go use di resources wey dey available take work…
University of Benin don suspend student union gworment becos of di attack wey happen to LP gwornorship candidate
University of Benin, Edo state don suspend di Student Union Gworment SUG till further notice, becos of di attack mata wey be happen to Labour Party gwornorship candidate wey bi di person of Olumide Akpata. According to di Registrar Ademola Bobola, im tok say di university management approved dis suspension wey don already start since Monday 29 2024. Im com add say dem don set up caretaker committee in di main time wey go dey conduct student mata, and dis committee get representatives from faculties, schools and institute.
Ondo state gworment don tori say di N5billion for day care renovation na error from printer
Ondo State government don com clarify di mata wey tori pipo bi carry about how di state for dia budget wan take use N5billion take renovate one day care, dem tok say na printer nai cos di error. Na Sahara reporter be report di mata of how di state bi wan take use di N5billion take renovate day care, dem com salute Sahara reporter say na dia eagle nai detect di error. You fit read di complete story for Ondo Government Says N5Billion Budgeted To Renovate Daycare Centre Was ‘An…
Court don troway di challenge wey bi dey against Edo state PDP gwornorship candidate
Federal high court for Abuja, don troway di mata wey some pipo bi carry go court to challenge how di PDP Edo state gwornorship candidate, Asue Ighodalo, take becom candidate for di gwonorship election wey go happen for September. As Justice Ekwo dey giv di judgement on top all di different mata wey dem carry com, di Judge com rule say all of dem nor get beta ogbonge evidence to prove to di court wey go make di court cancel di primary election.
Federal gworment don approve increase of salary for civil servants
Remember say di Nigeria Labour congress NLC, don dey waka upandan since for dis salary increase for workers, base on di inflation wey almost everybodi dey face for di nation. We go say base on dis, Tinubu gworment don finally approve almost 25-35% increment for civil servants, and health sector dey among dose wey benefit from dis increment through di Consolidated Medical Salary Structure (CONMESS) and Consolidated Health Sector Salary Structure (CONHESS), as tori tok say some other sectors bi don first get dia increment. Na di Head of Press,…