Nigerians say na social media, laziness plus hunger nai make Jamb result poor well well

Nigerians don tori say na too much social media, laziness plus di hungry wey dey land nai make student wey sidon write Jamb dis year nor pass well. According to di response to one post wey Tribune online do, Nigerians com tori say, e dey very bad say out of 1,989,668 students wey Jamb say register and sidon for di exam, a whole 1,402,470 com get score wey dey below 200. Some pipo com still tori say, students dese days nor wan study, say majority of dem na just to…

Osun state gwornor Adeleke say im neva borrow any moni since im resume office

Gwornor of Osun state, Ademola Adeleke, don tori say im never borrow any moni since when im become gwornor of di state. Di gwornor tori dis one wey im dey give di pipo report of e stewardship for di second edition of dia ipade imole forum. Gwornor Adeleke com tok say di rison wey im never boro any kobo bi say, di plan dey among di plan and di pledge wey im make, say im nor go boro moni, but im go use di resources wey dey available take work…

University of Benin don suspend student union gworment becos of di attack wey happen to LP gwornorship candidate

University of Benin, Edo state don suspend di Student Union Gworment SUG till further notice, becos of di attack mata wey be happen to Labour Party gwornorship candidate wey bi di person of Olumide Akpata. According to di Registrar Ademola Bobola, im tok say di university management approved dis suspension wey don already start since Monday 29 2024. Im com add say dem don set up caretaker committee in di main time wey go dey conduct student mata, and dis committee get representatives from faculties, schools and institute.

Ondo state gworment don tori say di N5billion for day care renovation na error from printer

Ondo State government don com clarify di mata wey tori pipo bi carry about how di state for dia budget wan take use N5billion take renovate one day care, dem tok say na printer nai cos di error. Na Sahara reporter be report di mata of how di state bi wan take use di N5billion take renovate day care, dem com salute Sahara reporter say na dia eagle nai detect di error. You fit read di complete story for Ondo Government Says N5Billion Budgeted To Renovate Daycare Centre Was ‘An…

Court don troway di challenge wey bi dey against Edo state PDP gwornorship candidate

Federal high court for Abuja, don troway di mata wey some pipo bi carry go court to challenge how di PDP Edo state gwornorship candidate, Asue Ighodalo, take becom candidate for di gwonorship election wey go happen for September. As Justice Ekwo dey giv di judgement on top all di different mata wey dem carry com, di Judge com rule say all of dem nor get beta ogbonge evidence to prove to di court wey go make di court cancel di primary election.

Federal gworment don approve increase of salary for civil servants

Remember say di Nigeria Labour congress NLC, don dey waka upandan since for dis salary increase for workers, base on di inflation wey almost everybodi dey face for di nation. We go say base on dis, Tinubu gworment don finally approve almost 25-35% increment for civil servants, and health sector dey among dose wey benefit from dis increment through di Consolidated Medical Salary Structure (CONMESS) and Consolidated Health Sector Salary Structure (CONHESS), as tori tok say some other sectors bi don first get dia increment. Na di Head of Press,…

There is hope

For Holy book, dem tok say, if life dey e mean say hope dey. As April don already end and we don enter May, my prayer for you bi say you go see di light, di opportunities, and di blessings wey go come from dat opportunity, and to see dese possibilities, you need to keep your hope alive. In odawise, no mata how your April take end, good or bad, try to keep your hope alive, with di beliv say di month of May go bring every good things and…