Nigerians don tori say na too much social media, laziness plus di hungry wey dey land nai make student wey sidon write Jamb dis year nor pass well.
According to di response to one post wey Tribune online do, Nigerians com tori say, e dey very bad say out of 1,989,668 students wey Jamb say register and sidon for di exam, a whole 1,402,470 com get score wey dey below 200.
Some pipo com still tori say, students dese days nor wan study, say majority of dem na just to make quick moni, and di worse bi say most parents still get part of di blame, since parents dese days nor dey ask dia children where dem for dey see moni, even when dem know say dia children nor get beta work wey fit giv dem di kind moni wey dem go dey spend at dat young age.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.