Remove negative thinking from your mind

God give human being di most powerful weapon as Him dey create us com dis life, and Him come use Him infinite wisdom take put dat weapon inside us.

Dat weapon if you ask me, na your mind.

If you know di power wey your mind carry, you go dey guide your mind with everythin wey you get, especially to guide am from negative/bad thinking.

But before your mind go become dat powerful weapon wey you fit take change anytin, you go nid to train your mind well well, and as I talk before one of dat training nah to wage war against negative or bad thinking.

As you start to wage war against negative bad thinking, you nor go suppose com leave di mind blank like dat, you go com begin to feed your mind with everything good, you go even nid to dey talk dis good tins wey you like to see, so dat your mind go dey hear wetin you dey talk, and as you continue to dey feed your mind with dis better positive talk and thinking, you go see say you don dey win d war against negative bad thinking, and you go also see am say things don dey change, becos in di first place, di first thing wey you nid to change before you go even start to see any new things, na to change di way wey you take dey think.

So as you dey go about your day, nor give chance to any negative bad thinking to hold you to ransom, banish them one time, at least make we start from dere.

Have a beautiful day and a beautiful week.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment