Di Transmission Company of Nigeria (TCN) don tori say light nor go dey for dia Amukpe substation for two weeks.
Dem tori say di outage na to help contractors get environment wey dey safe as dem wan put two 132KV transmission tower for Amukpe substation.
And becos of dis development, some communities for Edo and Delta state go face blackout for two weeks, becos say power supply nor go too much to Benin DisCo from Adeje industrial, woodland, Mosogar, Sapele and Abraka feeders during dis period wey contractors wan take work.
Na di general manager public affairs of TCN, Ndidi Mbah nai tori dis mata on Saturday, according to di general manager, dis work go start May 4th and e go end on May 17 2024
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.