Nigerian Communications Commission (NCC) don giv order make dem reactivate all di sim card wey telephone company be block sake of say dem neva link dem to di national identification numbers wey be NIN.
Na di NCC director of media and public affairs Reuben Muoka nai tori dis one today for im press release.
According to di tori, MTN don already start to dey activate di lines wey dem be block because say some consumers be nor link am with their national identification number.
Before then, some consumers bi don go tanda for MTN office wey dey round di kontry on top di sim blockade mata, before NCC com give order to reactivate di sim.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.